Recent Comments

Tuesday, 10 February 2026

PIDGIN: Exam Dey Come, Class Venue Come Turn War



By Ayomide Oguntade 

As exam dey run kitikiti com meet us, lecturers dey do giragira as dey won quick finish all their courses outlines befor exam land finish. 

For recent weeks, the crowd wey dey school plenti and classes no reach to contain everibodi. Lecture hall don turn to first come, first serve because na lecturer wey first come go use the hall for that period.

Students dey waka under hot sun just to find venue wey dey suitable for their population.

E dey dishearten say students wey suppose dey learn under better academic condition con dey sit down for fence abi window make dey fit hear wetin their lecturers they talk.

Sometimes, anoda department fit invade anoda department class make dem tok say na dem get venue which dey later lead to arguments among the students.

For interview wey we don follow students have, dey describe their experience as "frustrating" and "hectic".

Imoleayo Olupona wey be 400level mass communication student tok say she no pray to experience am again.

A 300level sociology student wey no wan mention her name tok say na wasted effort, energy and time whenever dey cancel their class be cos dey no fit find venue.

Meanwhile, Moyosore Oluwole wey dey 300 level for Computer Science department tok say na only when dey get fixed class, dem go dey find venue.

To dey find class venue no be like matter wey go end very soon for Adekunle Ajasin University, Akungba-Akoko but students don accept their fate.
Share:

0 replies:

Post a Comment

Blog Archive

Definition List

Unordered List

Support